Nasarawa Police Command don deny one tori wey dey fly up and down say two pupils for St Peter’s Academy, Rukubi for Doma Local Government Area, don kidnap during school activities. Dem talk say di gist no true at all, na just rumour wey no deserve make person publish as correct news.
Reputable sources bin report say some blogs and media houses first carry di tori say dem kidnap pikin for di school, and e cause tension for social media.
For statement wey dem release on Friday, di Police Public Relations Officer, Ramhan Nansel, talk say dem see posts for social media and some news outlets dey claim say kidnappers storm di school come carry two pupils.
He talk say, “The Command wan yan clearly say di report no true and e no represent wetin really happen.”
Nansel explain say around 10am on Friday, one unverified alert enter say two pupils don kidnap as dem dey do sports for field.
As di report reach them, di Commissioner of Police, CP Shetima Jauro Mohammed, quickly send one joint team of police and military personnel go check wetin sup.
He talk say, “On 21/11/2025 around 10:00hrs, one unverified report come in dey claim say two pupils of St. Peter’s Academy don kidnap during sporting activities. CP Shetima Jauro Mohammed immediately deploy Police and military team wey dey that area make dem rush go di scene.
“Wen dem reach there, dem discover say di pupils see some hunters wey dey carry dem gun. Na fear catch dem, so dem run because dem think say na kidnappers dey come.”
But we just dey hope say police no dey lie give us sha!
0 Comments